Ondo West

Afta Ilaje local goment, na Ondo West be di third largest local goment for Ondo State wit ova 150,000 registered voters.

Di pipo of Ondo West LGA na part of big numbers wey go determine di outcome of di election.

For history, dia numbers and election turnout dey always depend on whether one of di candidates come from dia region.

Dis time around, one of di former governor of di state, Olusegun Mimiko wey dey support one of di govnorship candidate of Zenith labor party, Agboola Ajayi, come from dat area.

Whether dis local goment go support dia local pesin for dis election or not, di outcome of dia votes na wetin go determine who go win and who no go win.

Owo local goment

Owo local goment hold di power of incumbency for di 2020 govnorship election.

Di sitting Govnor of di state, Rotimi Akeredolu of di ruling All Progressive Congress, APC come from dis LGA.

Owo get 264 polling units wit voting power of ova 119,000 registered voters.

All eyes go dey on dis local goment as pipo dey expect say dem go vote dia own pikin.

If dem do or dem no vote dia own, whoever most of di registered voters put hand to support for Owo, fit tanda to win di 2020 election.

Wetin fit be di game changer dis time around na if di oda 15 local goment decide to support one of di govnorship candidates against di three big local goments

But most times di oda LGAs dey always align wit dis three.

Source: BBC News pigin

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *