Ondo State dey head to di polls on Saturday 10, October to decide who go lead di state for anoda four years.

Candidates dey expect to pull large number of votes from di 18 local goment areas of di state.

Di local goment na Akoko North East, Akoko North West, Akoko South East, Akoko South West, Akure North, Akure South, Ifedore, Ile Oluji/Okeigbo, Ondo East, Ondo West, Owo, Ilaje, Okitipupa, Ose, Odigbo, Ese Odo, Idanre and Irele

But all eyes for dis election go dey on three major local goment wey for Ondo State election history, dia voring power dey always decide who go win di elections.

Akure South

Akure South LGA na di largest local goment area for Ondo State wit population of ova 480,000 and ova 280,000 registered voters.

For di 2016 Govnorship election, Akure South wit 25,797 votes, give di sitting Govnor, Rotimi Akeredolu, di highest votes from any local goment.

For 2012, Dis local goment give Labor party di highest votes of 49,915 to make former Govnor Olusegun Mimiko to win im second term for office.

Di race to 2020 Govnorship election don near and dis local goment go take big decision wit dia voting numbers on who fit become di next Ondo State govnor.

Di govnorship candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Eyitayo Jegede come from dis local goment.

Wit 535 polling unit, election history for Ondo State don show say di PDP and di ruling APC party dey always drag to get their highest number of votes from dis local goment.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *